BNW Forums

 

The Voice of a New Generation

 

BNW Forums and Message Board

 

 

 

BNW: the Authority on BiafraNigeria

BNW Magazine 

BNW News: Current Headlines

 BNW News Archive

BNW Home

 

BNW Writer's Block

 WaZoBia @ BNW

Biafra Net

 Igbo Net

Africa World and BNW Africa 

Submit Article for Publication

BiafraNigeria Button

BiafraNigeria Button

 

BNW : Biafra Nigeria World Message Board: the Voice of a New Generation Post New Topic  New Poll  Post A Reply
My Profile | Directory Login | Search | FAQ | Forum Home

  next oldest topic   next newest topic
» BNW : Biafra Nigeria World Message Board: the Voice of a New Generation » BNW Entertainment: Home of B-Nollywood » Laugh it off @ the BNW Improv » Monica - na wha for una!

 - UBBFriend: Email this page to someone!    
Author Topic: Monica - na wha for una!
Surulere
Advocate
Advocate # 803

Advocate Rated:
1
Icon 1 posted      Profile for Surulere     Send New Private Message       Edit/Delete Post   Reply With Quote 
Nne anidi Nna
abeg, carry una eye read di ting wey i come find for one kain forum. As i dey read am finish laughta carry me shotaaay i nearly fall for ground:

"Dis Na story about Monica, if Monica no kill me I no go die again. That kind love no be wetin man go gain.

I carry Monica go for one party. She come leave me dey dance with suga-daddy. She jump up - she jump down. She jump igue. She come kick the old man comot for stage. People come dey ask me if she be sista hammer. Because this kind girlfriend na one big wahala.

I carry Monica meet my friend girlfriends. All of dem come dey introduction themselves. The first lady say im dey Uniland for Ajiro. Monica come tork say she dey Unipetro. So me and Monica come stay Lagos the next morning. I bring out maclean, toothbrush and some bread and butter. Monica wan do the one wey surprise my eye. Im carry the butter come brush her teeth. She come use maclean eat bread and tea. I buy am maltina, she dey ask me if na blood tonic and how many spoon she go drink for morning. I buy am trés bon peppermint, she chop am finish her teeth strong bangbangra like cement. She come dey ask me which kind love medicine be all this one.

Me and Monica go for cinema hall, for where we dey watch cowboy. Everybody for cinama dey blow big gramma. Meself no know say Monica sef dey blow gramma. Di first lady jump up say 'this is fantastic!'. Monica sef jump up say 'this is cocastic!'. Everybody wey dey dey come take cover. This my girlfriend na really shakabula. If to say dem carry Monica go for Iraq, America for no dey give dem tough missile.... Just to cut am short. Monica go look for work. For interview dem say may dem bring pass record. When Monica land everybody start to laugh, because she carry one carton full of record Damarara, Sunny Ade, Shina and Lenta Brothers. Na so Monica loose im work for Liver Brothers. When I go look for wetin we go eat, I leave Monica for house, may she dey play di video dey enjoy di music, before me I come everthing done turn to zero. She say di man wey dey inside television dey laugh am. Na she come carry hammer come take am nack am. When she enta for kitchen say she wan cook, the pounded yam strong pass Olumo Rock, I swear this girl go kill me with love.

Gbosa, di last thing wey Monica do really pain me. If una hear am una go sorry for me. Monica done make us loose our visa when we wan go honeymoon for America. Dem just ask am simple question for embassy: Monica just start to dey blow big gramma. She say Nigeria have lot of mineral resources. Dem say 'can you mention one, just two or three?' She say 'small that one na simple question, we get Coke, we get Fanta, even 7up'. Na there me I come take cover."

___________________
OjuElegba - Moto dey come from North, South, East, West, Up, Down, Centa and Middul.

Posts: 21 | Registered: Nov 2004  |  IP: Logged
   

Quick Reply
Message:

HTML is not enabled.
UBB Code™ is enabled.

Instant Graemlins
   


Post New Topic  New Poll  Post A Reply Close Topic   Feature Topic   Move Topic   Delete Topic next oldest topic   next newest topic
 - Printer-friendly view of this topic
Hop To:


Contact Us | BNW: Biafra Nigeria World | Privacy Statement

Copyright © 2001 - present, BNW: Biafra Nigeria World. All rights reserved.

Powered by Infopop Corporation
UBB.classic™ 6.7.2

BiafraNigeria Banner

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

 

BiafraNigeria Spacer

BiafraNigeria Spacer

 

BNW Forums

The Voice of a New Generation